VAIDS

Tuesday, February 12, 2013

Keshi don do about turn

De Naija Supa Eagus manija, Stephen Keshi don accept to carri on with im job afta de Naija Sports minista, Bolaji Abdulahi settle de wahala wey dey happin betwin him and hin Oga dem wey be NFF pipu.


Oga Keshi don annouce on Monday for one radio Metro FM for South Africa dat hin don resign wen one amebo reporta wey be Robert Marawa carri am go de show.

But de minista wey na him dey control sports for Naija kon folow Keshi tok say make him continue as de coachi of de Supa Eagus wey na dem be de Baba for Africa.


One amebo wey dey de Naija camp for South Africa kon yarn us for supersport.com dat Keshi and de minista don sit down tok and Keshi don gree to carri on with hin job.


“Keshi don gree to withdraw hin resignason leta and hin go remain as de Supa Eagus coachi, but wetin him and de minista tok na hin me I no know,” Naso de amebo take yarn us.


De Naija Supa Eagus go arrive today for Abuja wia de Naija presido, Goodluck Jonathan go welcome dem for de presidential villa wey de for Aso Rock.

No comments:

Post a Comment

Share

Enter your Email Below To Get Quality Updates Directly Into Your Inbox FREE !!<|p>

Widget By

VAIDS

FORD FIGO